05/06/2026
The xi eleven of men wey sabi, legends of the game demπ₯΅π―
Old but not tired, them still dey ball like youngsters β½π₯
As E Dey Hot Ball π₯
Real football gist, hot takes & match reaction in Pidgin
No filter. No long talk. Just ball.
05/06/2026
The xi eleven of men wey sabi, legends of the game demπ₯΅π―
Old but not tired, them still dey ball like youngsters β½π₯
05/06/2026
Erling Halaand no even give this low-key bobrisky small chance to make his Agege move at all ππ...
He even put 100% masculine man, and I know say the guy for collect plenty blows if two of them dey inside one room ππ
Agege don see superstar π
No forget to follow us as we go dey give you sharp sharp ogbonge football gist,confam update, legit news and analysis π―π€
04/06/2026
Ghana black Stars no be only to dress well and snap pictures oo, make una no play rubbish as usual π€π..
Imagine 7 games without a win, una no get legs??, make we dey watch una shaa ππ
04/06/2026
Everything wey happen this season no be small cruise ππΏ
Arsenal dog dey celebrate EPL while Bruno dey celebrate Player of the Season. ππ
Chelsea no go smell any European football next season. π«βοΈ
Max Dowman don become the youngest player wey lose Champions League final. ππ
Carrick take over Man United when dem dey 1οΈβ£6οΈβ£ position, while Chelsea dey sit down for 1οΈβ£st position.
Season come end, Man United finish 3οΈβ£rd, Chelsea come land 1οΈβ£0οΈβ£th. ππ
Gabriel miss penalty wey for fit save dem from missing Champions League glory after all the funding. ππ₯Ά
This season na one kain season wey no fit ever comot for football history books. ππΏ
Follow As E Dey Hot Ball for more ogbonge update, football gist, analysis and legit updates π₯ π₯΅ π―
04/06/2026
Real Madrid own na to dey use style to kolombi players in a low key, them go just promise you plenty things for back then leave for small time π€£...
Na you go just use your hand go sign for them for free, and your club go come loose money wey them suppose get from your head π€π«π€£
But my question be say, this wey them dey do, e good? No be juju be that π€... E sure say no be curxs wey some club don curxs them dey affect them like this? π€π€£
Wuckedi club π
03/06/2026
If you don dey watch football games when these guys dey ball, na em be say you sef don tey for this football life oo ππ
Drop their names for comment section if you no be pikin for this game π€π
03/06/2026
And no be Arsenal fans dey buy am oo, na Chelsea and Man United fans dey rush am like hot cake ππ
Football fans sef ππ
03/06/2026
This boy think say Chelsea dey follow players play oo, na crazy tattoos you dey focus on instead of to scores goals for the blues.. ππ€
Them just dey watch Gernacho shaa, if he no deliver next season ehh, he no go even know the name of club where them go carry am go keep for loan ππ.... Make he dey zuzu.
02/06/2026
If Chelsea really wan compete with menh dem next season, they suppose do everything to keep Cucurrella... βοΈπ€
This guy na player wey dey play with all em body and life, he dey run like say em life depend on it, Cucurrella na agba baller π―β½
Chelsea fans wetin you think about this rumor?? Say your mind for comment section π€
02/06/2026
Make I no lie, this Chelsea new home kit no fine πππ€..
Abi na camera? How una see am π
#