Football Yarns

Football Yarns

Share

The main koko be say, we jus dey yan football awa style.

14/07/2026

Mbappe and Olise and Dembele don jabo from the 2026 World Cup after Spain show dem shege 2-0 for their semi final match wey shele this night. Spain play France total football sotay Digne use total pressure kick Yamal like Jackie Chan inside 18 yard box wey make ref award PK to Spain. Oyarzabal convert to make am 1-0 after first half. Na for second half Spain complete the mission Porro sneak enter France 18 yard box hang the ball inside net to make am 2-0 and send Spain to the final.

My people how una see the shege wey Spain show France today so?

14/07/2026

Just to remind una say some Chelsea fans try to convince us say England no go go far for the World Cup because dem no carry Cole Palmer. My prayer for you today na to fit identify the people wey go carry you far in life and disregard the noise from people wey go tell you say e no go work.

Una good morning my people.

13/07/2026

We don dey hear now say Argentina don run go meet FIFA knee down for ground dey beg FIFA say: abeg make una allow us wear our blue away jersey take play England for our semi final match on Wednesday. Because na that jersey we wear when we beat England for France 98 on penalties for round of 16. And na that same jersey wey we wear when we beat England for Mexico 86 wey Maradona score Hand of God for the quarter final. As we don wear am beat dem for Round of 16 and for Quarter Final, now na the time to wear take beat dem for semi final. In fact the 2 times wey England beat us for World Cup, for 1966 and 2002, na that our first white and blue we wear. So as you can see, na that blue jersey wey look like Chelsea own naim our Babalawo and Ezemmuo put the otumokpo wey dem prepare for England so allow us wear am so that Baba jazz go work well.

My people FIFA don kuku give Argentina to wear the away jersey. My people shay this blue Argentina thunder go strike for England head for the third time?

13/07/2026

Football legend, Zlatan Ibrahimovic don come outside dey blast Belgium coachie and officials say: How una go remove Courtois bring in Senne Lammens say na him be una second choice keeper? Because him dey play for Manchester United? Una think say na everybody wey dey play for Manchester United naim sabi play ball? All that glitters is not gold o and no matter how Lammens dey shine una for eyes, una no suppose put am for match. Abi una no read the history of how United take sign Lammens? Na emergency keeper be that guy because Onana wey be the original keeper turn out to be basket. So United just look say, which keeper dey wey dem fit carry now make dem no spend too much, na so dem carry Lammens. The guy na emergency keeper and emergency keeper na the keeper wey you no suppose put use during emergency. But the other keeper wey better pass Lammens, una dey overlook am because him no dey play for Manchester United. I no pity una o. Because na una use una hand ej*****te una sef from world cup because una go dey trust Manchester United player.

My people how una see this kind wahala wey Ibrahimovic carry come so?

12/07/2026

As referee dash Switzerland red card take open the door for Argentina to hammer dem 3-1, my prayer for you na make God dey remove all the obstacles for your way make you hammer in life. Una good morning and happy Sunday my people.

10/07/2026

Manchester United keeper Lammens do World Cup bonanza today after him vomit ball wey Arsenal boy Merino take score the winner wey Spain take beat Belgium 2-1. Na Fabian Ruiz tap in the first goal before De Ketelaera use one powerful header take equalise 1-1 after first half. Na late in the second half naim Cubarsi fire shot from Okoko wey Lammens no fit catch, only for Arsenal midfielder to shoot the winner inside net and shoot Belgium out of the World Cup.

My people how una see this kind bonanza by Manchester United first choice so?

08/07/2026

As Lionel Messi overcome the disappointment of missing penarity to become the only man alive to score for 9 straight World Cup matches, my prayer na for you to dey recover from disappointments and achieve great things in life.

Una good morning my people.

07/07/2026

Messi drag Argentina from 2-0 down straight to the quarter final of the World Cup after dem beat Egypt 3-2 for their Round of 16 match. Egypt really ready for the match as dem quickly use one bascard header take make am 1-0. Dem give Argentina penalty wey Messi miss and na for second half Zico score the first one wey VAR cancel before him score the one wey make am 2-0. Na then Messi start him crase with one bad crossing wey Romero convert to make am 2-1 before Messi himself use one bad volley take scatter net make am 2-2. Na inside injury time naim Chelsea boy Fernandez connect with Martinez cross to head inside net make am 3-2 and send Argentina straight to quarter final.

My people how una see wetin this GOAT and Argentina do so?

07/07/2026

The body of some people GOAT dey reject World Cup. Ronaldo be like: Anu arum choro kam buru World Cup. Mana achoyim ime ihe anu arum choro, eligwe lekwa m.

06/07/2026

Cristiano Ronaldo no go win World Cup for him career after Spain beat Portugal jabo from the World Cup. The match boring from first half enter second half and na very late into the match naim Arsenal boy Merino use one sweet run take useless the full Portugal defence before shooting the ball inside net to make am 1-0 and send Ronaldo packing from the World Cup with him 3 goals.

My people World Cup no go enter Ronaldo cabinet. How una see this matter so?

Want your business to be the top-listed Gym/sports Facility in Lagos?

Click here to claim your Sponsored Listing.

Location

Category

Telephone

Address

Lagos